Pankeeroy Arrested by the Efcc


"Pankeeroy arrested": [EFCC arrest Nigerian instagram comedian Pankeeroy]

WIA DIS FOTO COME FROM,EFCC/TWITTER

EFCC don arrest Pankeeroy, di Nigerian Instagram comedian wey real name be Nwagbo Oliver Chidera, for alleged fraud.

Di social media Influencer land di Nigeria corruption police net on top accuse of alleged internet fraud for Lagos, Nigeria commercial capital.

Operatives of di Lagos Zonal Office of di Economic and Financial Crimes Commission [EFCC] say dem bin arrest Pankeeroy for wia e dey for James Court for Lekki.

Pankeeroy, wey get over 500,000 followers on Instagram, bin chop arrest alongside 34 oda suspects on top accuse say dem allegedly get hand for one computer-related magomago alias 419.

EFCC gbab dem on 21 April, afta di commission receive intelligence report on top dia alleged criminal activities.

Di anti-corruption agency add say until im arrest, Pankeeroy wey claim to join Bitcoin scam afta e suffer depression, bin dey show himself as dealer wey dey epp pipo change dia bitcoin receipts.

Dem recover one motor wey worth N36, 000,000 (Thirty-six Million Naira) from wia dem arrest am.

Police tok say dia Investigations also show say di suspect get N22, 300, 000. 00 (Twenty- two Million, Three Hundred Naira) worth of Bitcoin for im block chain account.

BBC Pidgin no fit reach Pankeeroy for comments afta dem arrest am and e lawyer no pick e calls. But e fans ask EFCC to properly investigate di matter before dem judge am guilty. According to dem na only court fit decide weda im dey guilty or not.

One of Pankeeroy fans wey im name na Emmy Chief, tok say "e no be fraudster, make EFCC go investigate di matter well and if e dey innocent, make dem allow am dey go im house."

Comments